Posts

Showing posts with the label Pigin Paarol

Jumpikokus aureus: deezeez wey don show forr Naija aagain.

Image
Awa politishans dem don caash dis deezeez, com turnn fuurog. Ona wecom to Pigin Paarol. Mai name na Pipiro. Aand, tohday, we go chook maut insaaid de teribu elekshun deezeez wey don show face aagain laidis forr Naija. De name na Jumpikokus aureus : dis na deezeez wey dey kos pesin tto dey jumpi-jumpi upandan. E fit be furom wan maan tto anoda maan; or furom wan woomaan tto anoda woomaan; or furom wan paati tto anoda paati. Ehen. Awa politishans dem don caash dis deezeez, com turnn fuurog. Na so dem dey jumpi-jumpi furom wan paati tto anoda paati. De wan wey bursss mai dada na de tori say awa oga pkatapkata forr senate haus, senetorr Bukola Saraki, sef don caash de deezeez, com jump—fiam!—furom APC tto PDP. We neva knoww wai awa oga port o. Buht som pipu say na APC sweepu sweepu naim taya de man, im com desaid tto ggo res smol unda PDP umburella. Buht no be tohday dis Jumpikokus deezeez show o. Jumpi don dey Naija since 1999. Wetin we kol Civilian Ruul na wen awa sojas w...

Shey Uber Sopoz Dey Shaaj Goslow Forr Lasgidi?

Image
 I wan ass Wuuba: wai ona dey nack shaaj ontop goslow forr Lasgidi wey be de Fedra Capita of Goslow?  Wuuba , abi na Uber, make ona no evun maik me vex. Maik ona no jus maik me paran ontop ona matta. Ifaa no busss pesin taya, maik ona kol me baskard. Imajeen o. Ona wecom tto Pigin Paarol, o jare. Na Wuuba dey maik me vex o. Imajeen. I import wan Hailand chikito laidat com my Mecca de oda day. Chikito say, "nah, my car is faulty, and I don't do commercial buses". Baizd on Hailand chikito naa. I say, Okay, maik I kuku buuk Wuuba forram. I yuzz dem Wuuba App, aand e tehh me say from Hailand wia dem go peek de chikito tto mai mecca forr Iba Estate na aarand treeh taazan naira. I buuk am laidat. Nau, dis Wuuba draiva com carry Hailand chikito ggo sidon brekete forr insaaid confam goslow. Wen dem reesh mai mecca, Wuuba draiva opun im smellin maut tehh me say im Oyonkometa dey reed sevun taazan. Wuuba Onyokometa.   I say maik im yuzz maiscroscrope shekam ...

FAKE SAFITIKATE AND NAIJA POLITISHANS.

Image
        Shey dem no dey shain torchlait ontop pipu safitikate beeforr dem enta Govment pochichon?  Ona wecom to Pigin Paarol. We don land, com pochichon forr hia. Tohday, matta wey dey graawnd na FAKE SAFITIKATE AND NAIJA POLITISHANS.  Yuu see, fake safitikate don turnn norma teeen forr naija politishans. De oda dayy, na Senetorr Him-no-dey-laiyi, de wan wey we com knoww az ajeku iya. We jus commot maut from Hanty Adeosun fake NYSC safitikate. Naw, na awa oga wey de dans dans for Senate haus, wey we dey call Senetorr Adeleke alias De Dans Dans Senetorr . Briz don blo com opun fawu yansh say Senetorr Adeleke no ggo Univasiti forr Obodo Oyibo as im tok. Awa kweshun be, shey dem no dey shain torchlait ontop pipu safitikate beeforr dem enta Govment pochichon? Wai e dey taik so longg beefor dem com faind aut say dem politishan dey yuzz fake safitikate? And wai evriteeen dey hapun jus as we dey nia elekshun? Abeg, maik ona no sheef yansh. Pipi...

Wetin We Gain?

Image
Wetin be de main teeen wey we com laif tto gain? Ona wecom tto Pigin Paarol. Mai name na Pipiro. Aand tohday, we ggo shook maut insaid de wan wey we kol WETIN WE GAIN? We kollet dat Memori Vass ffrom dis korrekt muzishan wey im name be Victor AD. If yuu neva hia im muzik, yuu fit geht am ffrom HIA . Im muzik dey buss dada forr streeet nau, aand im sing say:  "If we no maik moni, wetin we gain?" Dat na confam kweshon. As soffa soffa fuull Naija so, wey pipu dey pkai henyhaw, if peson go pkai beefor im evun enjoi dis laif, wetin im gain? Buh awa kweshon for tohday be: wetin be de main teeen wey we com laif tto gain? Dat wan teeen wey be say if we no geht am beefor we dai, we don luuz be dat. Abeg, maik ona no sheef yansh.

Pigin Paarol

Image
Ona wecom tto mai kabal. Forr Pigin Paarol, we ggo dey yaan abaut orishirishi matta. Aand evriteeen ggo be forr confam Naija pigin, no Ingilishi forr hia. So ol doz pipu wey no dey undastan pigin, maik ona runn ggo len am o. Mai name na  Prospero O Anuforo ; buh mai frens dem dey kol me  Pipiro,  becos I sabi torrtorri pipu witt mai tori, no be smoll. Dem mai tori aand puem don evun show face forr orishirishi jornals and magazins. Abeg, maik ona no sheef yansh. Tto see evriteen wey dey forr Pigin Paarol, kiliki:                       HIA .                                  MAI KONECT:               Email: pipiro44@gmail.com               Twitter: @pipiro44                IG: @pipiro144.