Shey Uber Sopoz Dey Shaaj Goslow Forr Lasgidi?

 I wan ass Wuuba: wai ona dey nack shaaj ontop goslow forr Lasgidi wey be de Fedra Capita of Goslow? 



Wuuba, abi na Uber, make ona no evun maik me vex. Maik ona no jus maik me paran ontop ona matta. Ifaa no busss pesin taya, maik ona kol me baskard. Imajeen o.

Ona wecom tto Pigin Paarol, o jare.

Na Wuuba dey maik me vex o. Imajeen. I import wan Hailand chikito laidat com my Mecca de oda day. Chikito say, "nah, my car is faulty, and I don't do commercial buses". Baizd on Hailand chikito naa. I say, Okay, maik I kuku buuk Wuuba forram.

I yuzz dem Wuuba App, aand e tehh me say from Hailand wia dem go peek de chikito tto mai mecca forr Iba Estate na aarand treeh taazan naira. I buuk am laidat.

Nau, dis Wuuba draiva com carry Hailand chikito ggo sidon brekete forr insaaid confam goslow. Wen dem reesh mai mecca, Wuuba draiva opun im smellin maut tehh me say im Oyonkometa dey reed sevun taazan.

Wuuba Onyokometa. 

I say maik im yuzz maiscroscrope shekam again. Sevun taazan. Na flait I buuk? Plus im evun reesh late.

I wan ass Wuuba: wai ona dey nack shaaj ontop goslow forr Lasgidi wey be de Fedra Capita of Goslow? Aand, sontains, Wuuba draivas dey know carry pesin sidon insaaid goslow maik dem Onyokometa forr reeed beeg moni. Abeg, hau ona see dis matta? Shey Wuuba aand Taxify sopoz dey shaaj goslow forr Lasgidi? Aand evun if dem wan shaaj, e no sopoz be de saaim amaunt.

Maik ona no sheef yansh.




Pipiro na raita wey laik fain gehs wey sabi buuk. Aand na im pochichon ontop Pigin Paarol forr Asiri Media. 

Comments

Popular posts from this blog

Gym Guys & Johnny Bravo Physique.

ÀKÒDÌ ÒRÌṢÀ

EZIOBODO FUTO ROAD IS KILLING PEOPLE.