DIS NA MY PUEM.


"Na we pray pass, but na we still poor pass. Churches and mosques don cover wia factories suppose stand and dem say we dey jobless."

(Makes the sign of the cross).

Dear God,

Dis na my pain and my puem.

If I see any poor Naija pesin inside hell, I go know say some kain ojoro dey for Dai Kindom Come. Becos, here na too much hell already to fear for another hell.

                           1.
I see one family yesterday. Na food wey pipu troway inside duzbin na im dem dey gather to chop. So much for 'give us dis day, awa daily bread'. And when one of the boys open one
plate wey dey inside the duzbin, jam spoilt bread, im take hand chase away the flies com begin dey dance.

                          2.
I know another family, wey watch their daughter die for their hands sake of say dem no fit afford the hospital bill. The Mama no cry, she say wetin dey new say her daughter die, aftaroll, dis wan wey dem dey na life?

                          3.
You say Nkechi na striper for Owerri Club. Abeg, wia you bin dey when being clothless, hungry, jobless and hopeless na her full-time job?
You say Bose na Olosho for Oshodi. Abeg  you offer her beta job she refuse? And you, you say you no fit marry Olosho, but you marry Aunty Banker. You know  how many Sugar Daddies she bang to take meet her  bank target?

Bros, Olosho plenty, dem jus get grade: some dey corporate, de odas na culprit.

                         4.
God, abeg how you wan take judge? Sey you go judge the sin or the sakomstansis wey surround the sin?
Na we pray pass, but na we still poor pass. Churches and mosques don cover wia factories suppose stand and dem say we dey jobless.
How you take dey prepare our flesh  for fire still dey ask us to no end up for hell? The man wey die for ghetto yesterday suffer from birth to death, with records of mortal  sins for just grains of garri, while sombodi jus commit the small sin of signing a cheque and billions go disappear.
If you check am, no be awa fault; na destiny jus dey use us play video game.

                           5.
Look how awa girls and guys dey dare the desert and risk the sea to Europe and tell me say no be heavenly race. Look how white stand for divine and black stand for doom and tell me say color no mata. Tell me wetin goat do wey make dem go separate am from sheep.

                          6.
Sometimes I dey wonder: when dem kick devu commot from heaven, sey na for Africa im land. Senseless endless wars, killings everyday. Leaders packing money and amassing wealth like say dem dey save up for eternal life, only to die and get rolled up and buried in cheap mat.
Dem politicians eat suya and drink wine watching the starving kill each other for dem DiScord TV:
De oda day, herdsmen kill men for killing dia cowsDe oda day, dem hack Kristians to death for Cameroon; De oda dey, BH boys trow bombs and end lives. Las las, death don turn statistics.

                        7.
Seven seals from de vision of John. Seven continents. De richest of dem get de poorest people. Africa, shaped like a gun.
But dem pastors say make we dey pray,  make we hol on, becos on de Las Day. But wait, no be de day pesin die be im own Las Day? And afta death, no be judgement? But hia, e be like say dem don dey judge us even before we die.

Dear God,

No vex for me. Dis na my pain and my puem.

Comments

Popular posts from this blog

Gym Guys & Johnny Bravo Physique.

ÀKÒDÌ ÒRÌṢÀ

EZIOBODO FUTO ROAD IS KILLING PEOPLE.