Jumpikokus aureus: deezeez wey don show forr Naija aagain.
Awa politishans dem don caash dis deezeez, com turnn fuurog.
Ona wecom to Pigin Paarol.
Mai name na Pipiro. Aand, tohday, we go chook maut insaaid de teribu elekshun deezeez wey don show face aagain laidis forr Naija. De name na Jumpikokus aureus: dis na deezeez wey dey kos pesin tto dey jumpi-jumpi upandan. E fit be furom wan maan tto anoda maan; or furom wan woomaan tto anoda woomaan; or furom wan paati tto anoda paati. Ehen.
Awa politishans dem don caash dis deezeez, com turnn fuurog. Na so dem dey jumpi-jumpi furom wan paati tto anoda paati. De wan wey bursss mai dada na de tori say awa oga pkatapkata forr senate haus, senetorr Bukola Saraki, sef don caash de deezeez, com jump—fiam!—furom APC tto PDP. We neva knoww wai awa oga port o. Buht som pipu say na APC sweepu sweepu naim taya de man, im com desaid tto ggo res smol unda PDP umburella.
Buht no be tohday dis Jumpikokus deezeez show o. Jumpi don dey Naija since 1999. Wetin we kol Civilian Ruul na wen awa sojas wey hol pawa beefor-beefor commot dia khaki com wia haus clott. Abeg, no be dis same Jumpikokus aureus? Notin laik Civilian Ruul; na jus soja wey wia haus clott.
Mai kweshun tohday be: shey dem sopoz dey aalaaw politishans dey jumpi-jumpi enihaw? Sontaims, politishan ggo luuz elekshun forr wan paati com jumpi ggo anoda paati, or evun start neeu wan, tto draag pochichon. E don turnn awa politis tto shudren play-play. Aand e no sopoz be so. Wetin maik we duu abaut dis deezeez?
Abeg, I stiii pochichon ontop Pigin Paarol. Maik ona no sheef yansh.
Pipiro na raita wey laik fain gehs wey sabi buuk. Aand na im pochichon ontop Pigin Paarol forr Asiri Media.
Comments
Post a Comment