FAKE SAFITIKATE AND NAIJA POLITISHANS.

        Shey dem no dey shain torchlait ontop pipu safitikate beeforr dem enta Govment pochichon? 


Ona wecom to Pigin Paarol. We don land, com pochichon forr hia.

Tohday, matta wey dey graawnd na FAKE SAFITIKATE AND NAIJA POLITISHANS. 

Yuu see, fake safitikate don turnn norma teeen forr naija politishans. De oda dayy, na Senetorr Him-no-dey-laiyi, de wan wey we com knoww az ajeku iya. We jus commot maut from Hanty Adeosun fake NYSC safitikate. Naw, na awa oga wey de dans dans for Senate haus, wey we dey call Senetorr Adeleke alias De Dans Dans Senetorr. Briz don blo com opun fawu yansh say Senetorr Adeleke no ggo Univasiti forr Obodo Oyibo as im tok.

Awa kweshun be, shey dem no dey shain torchlait ontop pipu safitikate beeforr dem enta Govment pochichon? Wai e dey taik so longg beefor dem com faind aut say dem politishan dey yuzz fake safitikate? And wai evriteeen dey hapun jus as we dey nia elekshun?


Abeg, maik ona no sheef yansh.



Pipiro na raita wey laik fain gehs wey sabi buuk. Aand na im pochichon ontop Pigin Paarol forr Asiri Media. 

Comments

Popular posts from this blog

Gym Guys & Johnny Bravo Physique.

ÀKÒDÌ ÒRÌṢÀ

EZIOBODO FUTO ROAD IS KILLING PEOPLE.